Lyrics: Lade – Adulthood Na Scam

Lyrics: Lade – Adulthood Na Scam

 Lade - Adulthood Lyrics




Intro

Nobody go ask if you don chop

Nobody go send you free money

If you no get na you sabi

Adulthood na scam


Oh oh

Panra Panra

I heard that you’re looking for lade oh

Please don’t judge me

Cos I won’t judge you

Na wetn dem tell me I believe

Na wetn dem tell you you believe


Verse 1

As I wake up this morning (uhn uhn uhn uhn)

Landlord don call me (uhn uhn uhn uhn)

My padi don ring my phone say wey that thing wey you promise me (Lade wey the level na ?)

I no say you no go believe

Dem no tell me say na so е dey be

Abegi takе me back to days when e be say na just to play and chop ohh


Chorus

Eyy Ahhh

Adulthood na scam

You better get am for your mind (You better know this oh)

You gast to hustle, make a living 24/7

Nobody go ask if you don chop

Nobody go send you free money

If you no get na you sabi

Adulthood na scam


Verse 2

If you no get na you sabi

You no fit reason your padi oh

But if na dem need you, dem go come to you come dey give you different

Story oh (eh eh), Story oh (ehn ehn)

This is superstory oh

Though the story touch me oh

But I no fit send you money oh

If I say make I calculate (calcula)

Wetn I dey spend from Monday to Sunday (sunday)

Dey make me reminisce on those days

Wey pocket money go yapa for my pillow case (oh)

Now I gast send the money lole oh (lole oh)

Everything wey I want I must pay oh

Mogbe oh

I fit go give everything to become a child again


Chorus

Ahhh

Adulthood na scam

You better get am for your mind

You gast to hustle, make a living 24/7 (dem no dey person oh)

Nobody go ask if you don chop (dem no dey yarn person oh)

Nobody go send you free money (dem no go tell you yeah)

If you no get na you sabi

Adulthood na scam (big big scam oh)

Adulthood na scam (scam oh)

You better get am for your mind (oh oh oh oh)

You gast to hustle, make a living 24/7 (24/7 yeah yeah)

Nobody go ask if you don chop (24/7 oh)

Nobody go send you free money (dem no dey tell you yeahh)

If you no get na you sabi

Adulthood na scam (na na scam oh)


Outro

Leave me I wan become a child again

I wan become a child again

I want to play inside the rain

Cos Adulthood na scam